
Happy Friday to my Konfam Futubol!!! As e dey be like this en, Qatar, Denmark, Germany and Brazil don officially qualify for world cup wey dem go play inside Qatar next year. Other teams go digger am this weekend to book their own place for the world cup. Meanwhile, Stephen Gerrad don return back to the premier league
Nov 12, 2021
7 min

After 14 months in charge, Barcelona don finally tire for Koeman matter as dem kukuma say Oga, e don do, con dey go. Naso Dem take sack Koeman oo. Solksjaer yansh sef dey fire as Manchester United don give am 3 games to take do well. First of the games na against Tottenham on Saturday, how Ole go perform?
Oct 29, 2021
9 min

To my Konfam listeners, I hail o.. Dem just conclude the first leg for the league of the big boys (UCL), and for this weekend, domestic football dey come bigger and better. El Classico, Manchester United vs Liverpool and better better fixtures dey shele for Europe Leagues... Wetin go sup this weekend? Make una no forget to like United Tori page on Facebook, una fit also follow United Tori on Twitter and Instagram @UnitedTori. God bless una.
Oct 22, 2021
8 min

HAPPY FRIDAY MY PEOPLE...No be small something happen during this last international break o, as e be say the G.O.A.Ts of football (Messi and Ronaldo) been break and set new records for their country...... Big congratulations also to France as dem don win nations league... The Koko now be say, Premier league don return. JOY CHOKE.
Oct 15, 2021
11 min

Chiefs and Oga madam dem, I throway salute for una o๐๐๐.... This weekend of football wey just pass en, e no disappoint us at all... Plenty plenty tori just dey to talk about am.. make una listen to this episode to hear wetin sup for weekend.
Oct 4, 2021
13 min

Twale to my Konfam listeners๐๐๐.... Ronaldo and Messi still prove to us why dem be the GOATs๐๐ of football as both of dem perform wonders for this week champions league.... Liverpool Vs Manchester City tomorrow, how e go be?
Oct 1, 2021
10 min

Arsenal say omo, we no wan dey play with anybody again, now seriousness choke for dem as dem don win 3 straight premier league gamesโ๏ธโ๏ธโ๏ธ..... Dem say Premier league title is the goal๐๐. Man U and Chelsea sef Jones this week
Sep 27, 2021
11 min

Shoutout to my Konfam listeners.Lukaku and Ronaldo carry their fight from Seria A come premier league..... Salah sef no dey Jones as e be say this season golden boot race go choke
Sep 20, 2021
7 min

My Konfam people, I hail o, una boy loyal.. This premier league season en, nobody know wetin go happen as e be say the league this year go choke wella. Man United, Man City, Liverpool and Chelsea, these team no come play.... Who among them go win league this season
Sep 13, 2021
28 min

Happy Friday to my Konfam listeners. As e be like this, no team come play for league o, as e be say all of them wan fight for the title especially the top 6 sides, Chelsea, Manchester United, Liverpool, Manchester City, Tottenham and Leicester . How the transfers wey Dem make go take help them win the league?
Sep 10, 2021
12 min
Load more
